As CFA Francs fol fo Kano, na so praiz of forin rice and lokal rice folo am fol o.
Akodin to di "survey" we News Agency of Nigeria, NAN bin du fo Singer market we de insaid Kano on Sunday, wan 50kg bag of forin rice we dem de se N13, 800 and N14 500 bifo na N12,500 nau.
NAN de ripot se Singer maket na di men di men maket fo forin rice and oda esenshal komoduti dem fo Kano citi.
Di "survey" kom stil sho se 50kg bag of lokal rice nau na N11,000, bot bifo na N12, 500.
Wan mudu of foreign rice we dem de bai N850 ou N900 bifo, nau dem de sel am N700.
Na so mudu of lokal rice sef kom daun to N550 from N650 and N700 we dem de sel am bifo.
As im de put maut fo di mata, di bifo bifo chairman of Singer Market Traders Association, Alhaji Abdul’aziz Dalhatu tok se na di CFA Francs we fol fo blak maket kom mek rice fol bikos na CFA dem de yuz bai rice.
“Bifo nau, 1, 000 CFA de ekschenj fo N620 bot sins Sunday, 1, 000 CFA na N540,” im tok.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.