Tuesday, June 21, 2016

Wi no wn si bega fo Abuja - AEPB

If yu bi strit hoka ou bega fo Abuja, taim don kom to pak yo lod go yo vilej.

Na wetin di chiaman of di FCT Special Task Team on Abuja Environmental Protection we bi  Sqn. Ldr. Abdullahi Monje tok bi dat.

Im tok am on Monday wen im kari im task fos go sho dia pawa fo Wuse and Jabi.

“Di taim we wi giv dem to komot fo Abuja don finish. Wetin rimen nau na to yuz fos.

“Enibodi we wi kach, na to kari am go court.

“If sombodi rifiuz to komplai wit di ruls and reguleshons we wi don set, wi go arest am.

“In short mek a tel yu, wi no wn si hokas and begas fo di senta  of Abuja. Mek dem komot kpatakpata fo Abuja strit dem.’’

Monje stil kom tok se afta dem don poshu begas and strit hokas finish, dem go kom poshu keke Napep and kabukabu pipul fo Abuja.

"Di fes tu na Keke Napep and kabukabu. Wi no wn stat wit keke and kabukabu pipul nau.

"Wi wn giv dem enof wonin so dat nobodi go tok se im no hie."

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories