On Wednesday, police arenj 2 men we no get adres, we dem giv dia nem as Idris Sodiya and Sodiq Odebiyi fo Isabo Majistret Court, Abeokuta fo di ofens of tochin wuman breast bai fos.
Insaid di court, polis kom put 3 ofens fo dis 2 akiuz pipul hed onto di levul of felony, breach of peace and assault.
Di prosekuto we bi Sajent . Idowu Ogunleye tel di court se na on Nov. 27, arand 7.30 in di morin fo Leme eria fo Abeokuta na im dem komit di ofens.
Akodin to wetin Ogunleye tok, Idris and Sodiq bin join bodi go toch di breast of Mis Rasheedat Adesina we bi student fo Lisabi Grammar School.
Shi kom ad se dis badnes we dis 2 pipul join bodi du na somtin we fit kos trobul insaid di skul and di komuniti.
Ogunleye tel di court se di 3 ofens kontraven sekshon 516, 360 and 248 of di Criminal Code Vol. 1, Law of Ogun Stet, 2006.
Wen di court ask di akiuz pipul weda dem de giulti ou not giulti, dem dinai se dem no de giulti at ol at ol.
As di tin kom bi, Magistrate, Mrs Fatimat Ojelade kom grant dem bail of N100,000 ich, wit 2 surety we get di sem amaunt of moni.
Shi kom ajon di kes to January 11, 2017.
Enihau, di court tok se di akiuz pipul go de kul dia bodi insaid prizin ontil dem satisfai dia bel kondishon.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.