Vice President Yomi Osinbajo don visit the leader of Afenifere, Papa Reuben Fasoranti for him village o.
Osinbajo bin go greet Pa Fasoranti for him daughter Funke Olakunri wey some bad guys wey carry big big gun bin kill for Ore road last week.
VP Osinbajo talk say wetin pain am pass be say pesin like Pa Fasoranti wey don serve Yoruba people and even Nigeria sef well well na him this gunmen go do this badness to.
Before him waka comot from dia, the VP bin promise baba say govament go make shuo say dem arrest the people wey do this badness.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.