Some Yoruba socio- political group dem wey include Afenifere , Agbekoya and Oodua Peoples Congress (OPC) don join bodi to give strong warning to Boko Haram.
Dis na because of the letter wey dem say Boko Haram bin write say dem dey plan to come cause kasala for Ondo State on November 1.
Dem say na one security agency carry the letter go give Commissioner of Police. As the tori come dey waka around, na im bank inside 4 lokal govament eria dem no gree open their office o.
As bank dem no gree work for Akoko North- West , Akoko North- East, Akoko South - West and Akoko South -East, na im pipul come dey travel go Akure to do wetin dem wan do for bank.
Unto dis levul, the toktok pesin of Afenifere wey be Yinka Odumakin come tell news Tori pipul say if Boko Haram try any nonsense, dem go regret am bikos nobodi don ever defeat Yoruba pipul for their land.
On top the same matter, the oga kpatakpata of OPC for Ondo State wey be Victor Olayemi tok say im pipul tranga to face any outside pesin wey go carry trouble enter Yoruba Land.
"We dey ready for battle - ready for enibodi wey wan carry war come meet us for Yorubaland. Nor be say we dey look for war, but we dey kampe to fight enibodi wey go carry any type of wahala come meet us for Yorubaland."
For the farmers group wey be Agbekoya, dat took say Boko Haram dey plan to come attack some bank for Ondo State na very big joke. Na wetin their National Secretary, Chief Olaolu Akinpelu bin tell Punch on Saturday be that.
“ Agbekoya Solidarity Movement of Nigeria dey battle ready to defend any part of the region and we will gbege them with all the arsenal wey dey our hand.
“ I hope say dem go hie the warning to comot eye for our area , otherwise, we go swoop on them and pursue them to their strongholds anywhere in the country.’’

0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.