For Nkem Timothy wey dey stay for Algeria, e be like say water don pass garri o. This 36 years old Igbo man wey dey also waka with the name Auwalu Audu been dey plan to enter Algeria through Niger Republic before NDLEA people come catch am for Sokoto. Na there rain wey no get cloud begin beat am o.
According to Sokoto State acting Commander for NDLEA , Bamidele Segun wey been talk through Director of Media and Advocacy, Femi Babafemi last Sunday, dem grab Timothy on top of okada around Baggage area for Illela border as him dey try to enter Niger Republic from where him go enter him base for Algeria.
As dem come check him load, wetin dem see there shock dem o.
Dem say the guy man carry 62 wraps of cocaine wey be say as dem put am for scale, e come dey nack 1.550kg. Dem come talk again say if the kaya enter market, na 1 billion naira dem go fit sell am.
NDLEA people talk say inside bottle of yoghurt dem na im Timothy been package the cocaine put. Dem say the suspect been carry ECOWAS passport wey show him name as Auwalu Audu, but him come carry him own mouth tell dem say na Nkem Timothy be him real name.
As e be now, NDLEA don dey torchlight the matter to see the other people wey join bodi with this guy man to do the badness.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.