Ivun insaid IDP kamp dem, pipul stil de du niu marej and born shidren fo dis chenj piriod we awa kontri de insaid.
Akodin to News Agency of Nigeria, NAN we tochlait di mata fo Pompomari Internally Displaced Persons kamp fo Damaturu, Yobe Stet , di Executive Secretary, Yobe Emergency Management Agency, Alhaji Musa Jidawa we bi olso Secretary of State Committee on Resettlement and Rehabilitation of IDP dem tok se insaid di last 20 mont, 22 hosband and waif don du wedin fo di kamp.
Jidawa tok se fo di sem piriod, dem born 81 pikin insaid dis veri IDP kamp. Im kom ad se 18 pipul bin kari waka go hevun fo di kamp.
Jidawa esplen se na 4211 IDP dem tek stat di kamp fo March 2015, bot nau, na mou dan 2000 pipul de insaid.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.