80 yiez old Alhaja Sikiratu Yekini, di moda of Super Eagles straika we don dai, Rashidi Yekini tok se sins ha pikin waka, shi no de si fud chop laik bifo.
Bikos of dat wan, shi kom stat to de sel bred so dat shi go de get smol smol moni to chop.
Alhaja Yekini bin tel Punch se sins Rashidi waka, nobodi de sopot am. Na di smol moni we shi de get from ha bred and biskit biznes and di smol rent from di haus we Rashidi bin biuld fo am na im shi de tek manej ha laif.
Ok na. Alhaja Sikiratu stil tel Punch se sins shi los ha pikin, Nigerian Football Federation, NFF neva du enitin fo am.
Shi say na durin Rashidi wan yie rimembrans Oyo and Osun State govament dem dash Rashidi im tu waif dem tu tu milion naira.
" Kwara Stet Govament bin promis os bot dem fol mai hand.
"I neva tey we som pipul bigin to help mi. I get wan grup from Abuja we opun bank akaunt fo mi. Dem don put som moni fo mi dia.
"Olso, Yinka Ayefele jos send som pipul to mi. Im bin rid abaut mai wahala fo pepa, di tori kom toch am sotey im send pipul to kom ask wetin a nid. A tel dem.
"Ivun sef, mai tori olso toch Chief Donatus Agu-Ejidike. Im kom hie bai imsef dash mi N100,000.
"Som wiks we jos pas, di waif of Kwara Stet Govano, Mrs. Omolewa Ahmed, bin send delegeshon we giv mi klot, fud, bivrej and moni.
"A de gretful fo wetin dem du fo mi. God go bles dem bot a stil nid mou."
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.