Economic and Financial Crimes Commission, EFCC bin kari bifo bifo govano of Adamawa State, James Baba Ngilari go Gombe General Hospital on Saturday afta di man bigin sik fo dia hand o.
Last Thursday na im EFCC go arest Ngilari bikos of di monki hand we dem say im put fo di shia we dem shia di $115m (N23bn) we bin kom from bifo bifo Minister of Petroleum Resources, Diezani Alison-Madueke.
Di Chairman of PDP fo Adamawa State we bi Joel Madaki na im tel EFCC say Ngilari kolekt N450m from di Diezani moni.
Naija Languej hie se smol taim afta EFCC put Ngilari fo ditenshon, na im di man bigin komplen se im de fil weak o. Bifo dem nou, di man jos de wos de go.
Hie wetin wan EFCC pesin tok: “Adamu admit se im bin toch di moni bifo Fidelity Bank pipul kari am fo bulion van go govament haus.
“Di ambasado ivun tok se na Chief of Staff to Ngilari we bi Hamman, and di akauntant to Adamawa State Govament Haus , Mrs. Aisha Waziri kaunt di moni kom konfam hau moch de dia.
"From dat taim as im tok, na dis tu pipul kom de help dia oga we bi Govano Ngilari to tek kia of di moni.
“Im tok se from dat taim, im no nou hau dem shia di moni and dem no giv am enitin insaid."
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.