Saturday, March 6, 2021

Yawa Don Gad For Engr Head As Pesin Wife Come Die For Him Bed.

Wahala for who no fit hold body. Police for Adamawa State don konfam say one 37 years old mama wey get two children don go die on top of married man bed as dem dey jolly demsef unto minimini wanawana level.
Adamawa Police Command talk say telecommunications engineer Lekan Agboola dey their net now dey explain how another man wife come manage die on top of him bed.

 Adamawa police talk talk pesin, DSP Suleiman Nguroje, tell news tori people for Yola say Agboola dey for criminal investigation department now dey explain how the woman take die for him hand.

Agboola tell police say him own wife and two children dey stay for Lagos. As body no be firewood na, na so him come dey use this woman wey be mother of two to release konji. Him say e don reach three years wey him and this him girlfriend Andi Lugas dey together.

As him talk am, on February 24, 2021, konji come hold am as e don tay small wey dem never dey together. Na so him carry him phone call Lugas make she meet am for house. Sharp sharp Lugas don land for him house o.

As dem come dey fire dey go, na so him come notice say Lugas body don strong like wood o. "As I see say she nor dey breathe again, I come call one of my friend dem wey advice say make I carry am go hospital. Na for the hospital dem tell me say the woman don die o." 

As the matter be now, the woman family dey talk say the die wey their pesin die no be ordinary o. Her sister Bridget don beg police make torchlight the matter well well so that dem go know the true true thing wey hapun.

Tuesday, March 2, 2021

DSS Japa As Babalawo Follow Sowore To Court (see piksho)

Who say African science nor dey work? No be small fear catch DSS people for Abuja on Tuesday as one babalawo carry juju swagger enter court as him own way to support Omoyele Sowore for him matter with federal government. 
Even the judge sef e be like say the thing come tire am as him come adjourn the case indefinitely.

See all the piksho for here.





 

Wahala For Corona Virus As Vaccine Don Enta Naija


  Nigeria don collect corona virus vaccine wey nearly reach 4 million doze. Nigeria been join bodi  with COVAX Facility to obtain the medicine. This COVAX Facility sef na  CEPI, Gavi, UNICEF and WHO join bodi come form am.

Around 11.30am na im  the kaya wey be say na 3.94 million corona virus vaccine dey inside been land for Nnamdi Azikiwe International Airport on Tuesday. AstraZeneca /Oxford na dem dey make this vaccine through the Serum Institute of India for Mumbai. 

The National Primary Health Care Development Agency talk say na the people wey dey work for health sector go first collect the vaccine.

Meanwhile, Edward Kallon wey be UN Resident Coordinator in Nigeria don talk say im team go do every every to make sure say dem stop corona virus for Naija.

Monday, March 1, 2021

See The Man Wey Carry N1b Cocaine Inside Yoghurt


 For Nkem Timothy wey dey stay for Algeria, e be like say water don pass garri o. This 36 years old Igbo man wey dey also waka with the name Auwalu Audu  been dey plan to enter Algeria through Niger Republic before NDLEA people come catch am for Sokoto. Na there rain wey no get cloud begin beat am o.

According to Sokoto State acting Commander for NDLEA , Bamidele Segun wey been talk through Director of Media and Advocacy, Femi Babafemi last Sunday, dem grab Timothy on top of okada around Baggage area for Illela border as him dey try to enter Niger Republic from where him go enter him base for  Algeria. 

As dem come check him load, wetin dem see there shock dem o.
Dem say the guy man carry 62 wraps of cocaine wey be say as dem put am for scale, e come dey nack  1.550kg. Dem come talk again say if the kaya  enter market, na 1 billion naira dem go fit sell am.

NDLEA people talk say inside bottle of yoghurt dem na im  Timothy been package the cocaine put. Dem say the suspect been carry ECOWAS passport wey show him name as Auwalu Audu, but him come carry him own mouth tell dem say na Nkem Timothy be him real name.

As e be now, NDLEA don dey torchlight the matter to see the other people wey join bodi with this guy man to do the badness.

Saturday, November 2, 2019

No Try Yoruba Land O, OPC warn Boko Haram

Some Yoruba socio- political group dem wey include Afenifere , Agbekoya and Oodua Peoples Congress (OPC) don join bodi to give strong warning to Boko Haram.

Dis na because of the letter wey dem say Boko Haram bin write say dem dey plan to come cause kasala for Ondo State on November 1.

Dem say na one security agency carry the letter go give Commissioner of Police. As the tori come dey waka around, na im bank inside 4 lokal govament eria dem no gree open their office o.

As bank dem no gree work for Akoko North- West , Akoko North- East, Akoko South - West and Akoko South -East, na im pipul come dey travel go Akure to do wetin dem wan do for bank.

Unto dis levul, the toktok pesin of Afenifere wey be Yinka Odumakin come tell news Tori pipul say if Boko Haram try any nonsense, dem go regret am bikos nobodi don ever defeat Yoruba pipul for their land.

On top the same matter, the oga kpatakpata of OPC for Ondo State wey be Victor Olayemi tok say im pipul tranga to face any outside pesin wey go carry trouble enter Yoruba Land.

"We dey ready for battle - ready for enibodi wey wan carry war come meet us for Yorubaland. Nor be say we dey look for war, but we dey kampe to fight enibodi wey go carry any type of  wahala come meet us for Yorubaland."

For the farmers group wey be Agbekoya, dat took say Boko Haram dey plan to come attack some bank for Ondo State na very big joke. Na wetin their National Secretary, Chief Olaolu Akinpelu bin tell Punch on Saturday be that.

“ Agbekoya Solidarity Movement of Nigeria dey battle ready to defend any part of the region and we will gbege them with all the arsenal wey dey our hand.

“ I hope say dem go hie the warning to comot eye for our area , otherwise, we go swoop on them and pursue them to their strongholds anywhere in the country.’’



Sunday, July 14, 2019

VP Osinbajo don visit Pa Fasoranti

Vice President Yomi Osinbajo don visit the leader of Afenifere, Papa  Reuben Fasoranti for him village o.

Osinbajo bin go greet Pa Fasoranti for him daughter Funke Olakunri wey some bad guys wey carry big big gun bin kill for Ore road last week.

VP Osinbajo talk say wetin pain am pass be say pesin like Pa Fasoranti wey don serve Yoruba people and even Nigeria sef well well na him this gunmen go do this badness to.

Before him waka comot from dia, the VP bin promise baba say govament go make shuo say dem arrest the people wey do this badness.


Tuesday, June 25, 2019

50% Of Abuja People Dey Shit For Public

Issorite! Nor be we talk am o. Na govament talk am.

Emmanuel Awe, wey be Director, Water Quality Control and Sanitation for Federal Ministry of Water Resources na im talk say 50 per cent of people wey dey live for Naija capital, Abuja dey shit for open place because dem nor see  public toilet to use.

Awe talk say na wetin the National Bureau of Statistics and UNICEF on water, sanitation and hygiene (WASH) Norms tell am be that.

Awe been speak for the meeting wey Water Supply and Sanitation Collaborative Council (WSSCC) do with Head Teachers of Primary Schools for Federal Capital Territory, Abuja.

Sunday, June 2, 2019

FOOD IS READY

Food is ready na for people wey get money. Bros if your pocket nor tell you true, no near  buka o.

Sunday, May 19, 2019

50% Of Abuja People Dey Shit For Public

Issorite! Nor be me talk am o. Na govament talk am.

Emmanuel Awe, wey be Director, Water Quality Control and Sanitation for Federal Ministry of Water Resources na im talk say 50 per cent of people wey dey live for Naija capital, Abuja dey shit for open place because dem nor see  public toilet to use.

Awe talk say na wetin the National Bureau of Statistics and UNICEF on water, sanitation and hygiene (WASH) Norms tell am be that.

Awe been speak for the meeting wey Water Supply and Sanitation Collaborative Council (WSSCC) do with Head Teachers of Primary Schools for Federal Capital Territory, Abuja.

Saturday, May 11, 2019

Man Kill Wife Over Area One Palaver

Police for Lagos don arenj 31 yiez old Godspower Johnson for Ebute Metta magistrate court o. Dem say Johnson bin beat him own wife sotay she come die because of area one wahala.

According to Inspector Oladele Adebayo wey be prosecutor for the matter, Johnson bin want do smol jolly with him wife Deborah around 5.30 pm. Na so him carry two fingers come shuk inside Deborah area one, but the woman no gbadun dat kain thing at all at all. Na so fight come start o.

Like play like play, na so Deborah wey be 31 yiez old come die for her own husband hand o.

This badness bin hapun on  March 21, 2019 arand 5.30pm for Adekoye Street, Igbo-Elerin, Ishashi, wey be say na dia  dem dey live.

After him don listen to the prosecutor finish,  Chief Magistrate O. O. Olatunji come order say Godspower go sidon for Ikoyi Prison, for the next 30 days wey be arand June 7. By that time, him go don receive  advise from Lagos State Director of Public Prosecutions.


Tuesday, December 25, 2018

Xmas Wahala: Cow don kill pesin for Sapele

Yawa don gas for one butcher head for Sapele, Delta state. Wetin cause the wahala na Christmas cow o.

Naija languej hie say Wasiu, 27 yiez old bin carry one cow dey go abattoir on Monday, December 24. As the animal see say na abattoir the man wan carry am enter, fear come catch am o.

Na so the cow come tear race enter road dey find way to escape. Na so Wasiu sef begin pursue the cow o .

As im look back see say pesin dey pursue am, na so the cow match automatic break come pack Wasiu with im horn come nak am for grand two times.

Like say dat one nor do am   , the cow come match the msn bele before im come tear race again.

Before pipul go arenj help come, Wasiu don waka join im ancestors.

Sunday, December 16, 2018

Na wa o! Woman with big chest just dey cause kasala fo Instagram

No be smol tin dey hapun fo Instagram now o, as men just dey run upandan to luk the piksho of one woman wey carry big big watermelon fo chest.

Confidence Adannaya Offor aka Creamy Dency dey sew clothes wey she dey sell for Instagram, but the big big bobi wey she carry don confuse men sotay even those wey no plan to buy her clothes just dey buy  sake of say make dem get chance to try their luck with the woman.

We fo Naija Languej just dey wonder how she dey carry dat kain heavy load dey waka about. But then, our pipul talk say ikebe no dey heavy the owner.

Make una carry una eyes see wetin we sef see fo Instagram.

Sunday, July 29, 2018

Naija Proverb Corner.

Run wey no be run na im woman dey run hold hand for breast run.

Thursday, March 22, 2018

Wetin Boko Haram tel Dapchi pipul on Wednesday

Boko Haram don giv serious warning to Dapchi pipul mek dem no eva try to send dia girls to skul again.

On Wednesday, na im Albarnawi and im boys fo Boko Haram giv dis warning as dem kom return arand 100 skul girls wey dem kidnap last month.

Sekuruti pipul bin ful grand fo Dapchi  vilej insaid Yobe stet on Wednesday wit Non-Governmental Organisation, NGO pipul dem plos dem papa and mama and family memba of di skul girls di time wen Boko Haram bin  bring dem back arand 8 o'clock in di morin.

Na im Boko Haram kom tel dem say wetin dem sopoz to do fo di girls na to find husband fo dem as dem don reach to born pikin.

Luk piksho fo onda.

Pipul de tok about wetin pastor pikin wear du wedding fo choch. (Piksho)

So on Monday, Miracle, we be daughter of Pastor Esenam, kom wear her ogbonge wedding gown for kom choch bikos na her wedding day be dat.

Isorite bikos na nomal levuls be dat. But wetin kom mek pipul de tok be say di wedding gown kom dey opun fo chest sotay half of Miracle breasts dey outside.

Na im pipul kom de wonder say "no be pastor pikin be dis? Which kain wedding gown be dis wey be say her breasts de sho ?"

Okay na. Kari yo oun eyes luk di piksho dem fo onda. 

Sunday, March 18, 2018

Army kapsho herdsmen wey de spoil farmland fo Benue

Naija soja dem wey kom from 707 Special Forces Brigade don kapsho anoda 12 Fulani herdsmen wey join bodi de spoil pipul farmland fo Benue stet. 

On 17 March 2018, na im dem gbab dis pipul as  Presidential Assessment Team de visit MBAYER/YANDEV and KAAMBEE ward dem fo  Benue Stet.

Si dem fo piksho we de onda.

Monday, February 5, 2018

Wetin mek Owerri wuman join hand wit boifrend brek hosband head?

Wen somtin wey pas rabit folo rabit enta hol, na big wahala bi dat o.

On Monday, won man de waka im oun jeje fo Amaigbo strit, insaid Owerri. Na im di man kom si anoda man put hand fo im waif waist de komot fo won hotel we ashawo pipul de stay.

Akodin to som pipul we dey dia, di man no fit biliv wetin im aiz de si o. Na so im pak im moto go grab im waif.

"So na wetin yu de du bi dis?"

Bifo im go tok finish, im waif and ha boifrend bigin beat am o. Bifo pipul go ask wetin de hapun, di wuman boifrend don kari stik brek ha hosband head o. Dem say na di ouna of di hotel and som ashawo pipul dia kom save di man.

As dem sepret di fight finish, di wuman kom de tel pipul say wetin mek am folo man go hotel bi se ha hosband no de giv am moni.

"Sins a mari dis man, im no de sopot mi fo enitin.

"If I ask fo moni, im go say mek a wait. A don taya fo dis marej."

Di man kom tok say tiri days ago, im waif request moni to bai cloth bot im tel am say im wan pe dia shidren skul fiz fest of ol.

"Na im mai waif run komot fo haus kom switch ha fone off o.

"A jos de pas o bifo a kom si dis Okey de hold mai waif we a mari wit moni fo waist fo hotel gate.

"Na evritaim shi de tok wit dis Okey fo fone. If a ask hu bi Okey, shi go tok say na ha biznes patna bi dat.

"A no nou se na dis kain minimini wanawana biznes dem de du fo dis bad ples."

Na fo di pharmacy we dey nia di hotel dem go sow di man head.

Hau dem kari Olisa Metuh on top stretcher kom court (piksho)

Bifo bifo National Publicity Secretary of  Peoples Democratic Party, PDP, Chief Olisa Metuh bin sho face fo Federal High Court, Abuja on Monday bikos of N400m we dem tok say im bin kolekt chop onto mago mago levul.

Bot di koko bi say Metuh no kari im 2 leg waka kom court o. Naija languej tori hie se na kari dem kari di man on top stretcher kom court and if yu si am, yu go niali krai.

Na im Justice Okon Abang luk Metuh kondishon finish kom ajon di mata to March 14, 2018.

Afta ajonment, na im dem kari di man shap shap put insaid National Hospital, Abuja ambulans wit plet nomba , 44Q 20 FG kom riton am to hospital arand 10 :27 on Monday morin.

Akodin to EFCC, Metuh bin yuz wuru wuru levul kolekt 400 milion naira from bifo bifo National Security Adviser we bi Sambo Dasuki fo 2014.

Si piksho of Metuh on top stretcher as niuz tori pipul bin snap am fo court on Monday morin.

Friday, February 2, 2018

Hau DSS tek kapsho Rabi Ismail, aka Cecilia.

Join bodi na im Department of State Services, DSS and Nigerian Prisons Service tek kapsho Rabi Ismail we bi runaway prizina fo ova 6 yiez on Wednesday.

Kano High Court bin sentens Rabi to die in 2005 afta Justice Haliru Abdullahi don konfam se tru tru shi bin kil her lova boi biznes man Auwalu Ibrahim fo Kano.

Dem say Rabi bin de 39 yiez old di taim wen shi komit dis badnes fo 2002. Di court hie say Rabi bin put poizin insaid sweet fo ha boifrend bifo shi kom trowe di man insaid wota.

Dem say Rabi bin vanish from Hadejia Maximum Prizin fo December 2011 smol taim afta Supreme Court don konfam say shi go die fo di badnes we shi komit.

465 Naija pipul from Libya don land fo Port Harcourt


Akodin to Martins Ejike we bi South-South Zonal Coordinator , National Emergency Management Agency , NEMA,  465 Nigeria pipul we bin go hozul fo beta laif fo Libya don land fo Port Harcourt o.

Ejike we bi se na im risiv dis returnee pipul fo Port Harcourt International Airport on Friday tok say na arand 12 o'clock midnight dia plane toch grand.

Ejike tok say Fedral Govament de du evritin to mek shuo se evri Naija pesin we de hozul fo Libya riton bak to Naija.

Muhammad Dahiru we bi PRO fo Max Air tel niuz tori pipul say 1,955 pipul na im Max Air don bring back to Naija insaid 3,138 pesin we dem sopoz to kari kom bak from Libya.

Categories