Wahala for who no fit hold body. Police for Adamawa State don konfam say one 37 years old mama wey get two children don go die on top of married man bed as dem dey jolly demsef unto minimini wanawana level.
Adamawa Police Command talk say telecommunications engineer Lekan Agboola dey their net now dey explain how another man wife come manage die on top of him bed.
Adamawa police talk talk pesin, DSP Suleiman Nguroje, tell news tori people for Yola say Agboola dey for criminal investigation department now dey explain how the woman take die for him hand.
Agboola tell police say him own wife and two children dey stay for Lagos. As body no be firewood na, na so him come dey use this woman wey be mother of two to release konji. Him say e don reach three years wey him and this him girlfriend Andi Lugas dey together.
As him talk am, on February 24, 2021, konji come hold am as e don tay small wey dem never dey together. Na so him carry him phone call Lugas make she meet am for house. Sharp sharp Lugas don land for him house o.
As dem come dey fire dey go, na so him come notice say Lugas body don strong like wood o. "As I see say she nor dey breathe again, I come call one of my friend dem wey advice say make I carry am go hospital. Na for the hospital dem tell me say the woman don die o."
As the matter be now, the woman family dey talk say the die wey their pesin die no be ordinary o. Her sister Bridget don beg police make torchlight the matter well well so that dem go know the true true thing wey hapun.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.