Akodin to Martins Ejike we bi South-South Zonal Coordinator , National Emergency Management Agency , NEMA, 465 Nigeria pipul we bin go hozul fo beta laif fo Libya don land fo Port Harcourt o.
Ejike we bi se na im risiv dis returnee pipul fo Port Harcourt International Airport on Friday tok say na arand 12 o'clock midnight dia plane toch grand.
Ejike tok say Fedral Govament de du evritin to mek shuo se evri Naija pesin we de hozul fo Libya riton bak to Naija.
Muhammad Dahiru we bi PRO fo Max Air tel niuz tori pipul say 1,955 pipul na im Max Air don bring back to Naija insaid 3,138 pesin we dem sopoz to kari kom bak from Libya.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.