Sunday, December 31, 2017

HAPI NIU YIE TO OL NAIJA LANGUEJ LOVA DEM

Ol of una we de laik to rid Naija Languej blog, mi a de wish una hapi niu yie.

2018 go beta fo una. Onli beta beta tins go de hapun to una dis yie.

Wi fo Naija Languej de pre mek Baba God we de fo hevun sama una wit evritin we go mek una bele swit fo 2018.

Enibodi we say una wota no go boil fo dis 2018, im oun stov no go ivun lait at ol at ol.

Dis yie, wi go mek shuo se Naija Languej blog enta niu levul ivun as wi de pre mek ol of una enta niu niu levul fo una oun eria.

Una hapi niu yie ooo.

Steve Igbokwe

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories