Wednesday, June 22, 2016

Braib palava: Fayose de tok laik smol pikin - Presidency

Presidency don tok se dat tin we Ekiti Stet Govano, Ayodele Fayose tok se Madam Aisha Buhari bin folo US Congressman William Jefferson chop braib na smol pikin tok.

Sinio tok tok pesin fo Baba Buhari we bi Malam Garba Shehu na im tok dis wan fo Abuja.

Shehu say dem fo no ivun ansa dis kain yeye tok we Fayose tok bikos di man tu de laik mek dem de kari im nem fo niuz.

Bot mek Fayose no kom manej disiv som pipul wit im lai lai na im mek dem jos de ansa am.

Shehu kom chalenj Fayose to tel Naija pipul weda dat Aisha we im kom de shia ha piksho laik mumu get as shi tek rizembul di Aisha we bi Baba Buhari waif.

Fainali, Shehu kom tok se Aisha Buhari no get eni konekshon wit eni William Jefferson ou eni braib mata fo America.

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories