Friday, June 24, 2016

A no nou hau a manej go Kano - Ese Oruru

Ese Oruru, dat smol girl we Yunusa Dahiru bin kari go Kano, go mari am bai fos don court se shi no nou hau shi manej faind hasef fo Kano.

Fo di trayal we dem jos rizium fo Federal High Court, Yenagoa, Bayelsa Stet de bifo yestade, prosekushon loya we bi James Amate tel di court se Ese don born di pikin of di bele we Yunusa bin giv am bai fos.

Justice Aliyah Nganjiwa bin giv oda mek Ese giv ha evidens fo sikrit bot hie wetin pesin we de dia tok se Ese tok.

"A no nou hau a manej go Kano. A jos wek op si maisef fo Kano."

Yunusa stil de prizin as im no fit mit di bail kondishon we dem giv am, bot afta im loya kom beg di court to mek tins izi fo am, na im di judge ridiuz di kondishon o.

On July 1 na im di kes go rizium and na som loya dem we kom from International Federation of Women Lawyers, FIDA de riprezent Ese mama and papa dem fo di mata.

Dia lida na Mrs. Dise Ogbise.

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories