Sunday, January 7, 2018

Naija Languej piksho of di wik: Bikos of cow.

If yu laik yosef no faind Fulani man trobul nia im cow oo.

Bikos of nama, Fulani go giv u beta injuri. Dem fit kil bikos of cow sef.

Di man insaid piksho na Zion Peter wit im waif Jessica.

Dem say Fulani herdsmen go machet Zion insaid bush on January 1 , 2018 wen pipul de selebret niu yie. Wai bikos Benue Stet govament say mek dem no de kari dia nama enta pipul farm.

Eniwe, Zion get "luck" o. 20 of di pipul we jam angri Fulani herdsmen dat de no sovaiv at ol at ol oo.

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories