Fo Sule Olayiwola we de tich Arabic fo skul, wetin Ibadan Customary Court tek im aiz si on Monday, im maut no fit tok am o.
Omolara we bi Sule waif bin beg di court to end dia marej bifo Sule go kil am wit di kain panel bitin we im de du am evritaim.
Hie wetin di court tok.
"Yu dis hosband and waif, as una don strong hed se una go de liv laik agbero, kom de fait una sef evritaim, mi sef a don disaid to end dis una marej so dat una no go kari katakata kom spoil di fusho of una shidren. "
Bot wetin mek Sule krez bi se Mr Ademola Odunade, we bi President of the court kom kari ol di 4 shidren giv Omolara on top of kwich im go de giv di wuman 10,000 naira chop moni evri mont. Laik se dat won no du, di court stil tok se na Sule go de pe skul and medikal fiz fo dem.
As im kom rimemba se im oun sinio sista bin tel di court se im and im waif de olwez liv laik kat and dog, na im Sule kom woz di wuman konfam slap. Bifo pipul go ask wetin de hapun, im don de praktis Mike Tyson fo im sista bodi o. Di sekuriti pipul we bin de insaid di court na dem kom sev di wuman fo Sule hand o.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.