No bi fo Naija o. Una nou se fo Naija, choch no de dash pipul moni. Na kolekt dem de kolekt.
Bot fo Spoleto di smol vilej fo Italy, Father Gianfranco Formenton of the church of Saint Martin in Trignano de giv tank yu ogogoro to adolt dem we kom choch. To shidren, im de giv biscuit wit holi komunion wine.
Eniwe bifo yu kolekt enitin, yu go sho yo “Mass Attendance Card” o.
Im tok se im de du am so dat pipul go de kom choch wel wel.
Si wetin im tok fo Facebook. “Atenshon! From Sunday July 2, wi go de Celebret Mass by 11 am. Wi get air kondishon and fo di pipul we get ‘Mass Card’, wi get aperitif – prosecco fo di grown-up dem and Communion wafers and crisps fo smol smol pikin dem.” Na so di 57-yiez-old Rev Fada tok.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.