MMM Nigeria don stat to de pe smol smol moni to di pipul we get mavro (moni) fo dia hand.
MMM bin friz ol akaunt fo Naija durin Xmas taim bikos pipul we wn get help, GH kom plenti pas pipul we bin wn provaid help, PH.
Kolade Ogunwande we de manej MMM akaunt fo som pipul tok se im get kostoma we bin invest N20,000 fo November 10, 2016. As MMM kom rizium, im moni don gro to N35k. Bot as im wn komot di moni, na onli N17k alat im kom risiv fo im bank.
"Di 2 pipul we dem join togeda wit am sopoz pe N17k and N18k to komplit di N35k, bot na onli 1 pesin don pe."
MMM bin don tok am bifo se dem go fest pe pipul wit smol moni bifo dem go bigin luk rich pipul fes.
“As di sistem na to help pipul, wi go fest pe puo man and pipul we no get moni; na im bi se pipul wit smol PH go get dia moni fest.
“Big moni pipul fit wet. Eniwe, wi don de tok am sins se moni we yu sopoz to invest fo MMM na moni we no tu de impotant to yu. No nid to wori abaut enitin."
Na wetin dem rait fo dia website bi dat.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.