Saturday, January 21, 2017

Na lai o, Buhari neva die - Presidency

Prezidensi don dismis tatafo tok we de waka abaut say Prezident Muhammadu Buhari don waka go join im ansesto dem.

Di 2 pipul we de help di prezident fo midia and poblisiti mata we bi Mr Femi Adeshina and Mallam Garba Shehu tel niuz pipul on Saturday se Baba Buhari de kampe.

Fo Twitter, Adeshina tank ol di pipul we de pre beta preya fo Baba Buhari health ivun as im ask God to fogiv di bad bele pipul we de kari di lai lai tori.

"A de wish beta fo di pipul we wish PMB wel. As fo di pipul we de kari ivul tatafo tori, mek dem risiv gres to ripent. " Na wetin im twit bi dat.

Fo im oun twit, Garba Shehu tok se, " di prezident we go fo holide fo United Kingdom no fit de Germany at di sem taim, weda im dai ou im de alaif. "

Shehu stil kom tok se, "Baba Buhari no bi laik won bifo bifo Naija prezident we de fo Otta wit Obasanjo, kom stil de atend Donald Trump inogureshon fo Washington DC, minin se im bin de fo tu ples at di sem taim."

Rimemba se Buhari bin hand ova to Osinbajo as Acting President bifo im komot go UK on Thursday fo wetin prezidensi bin kol "odinari chek op."

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories