Polis don arest di pasto of Divine Yard Deliverance Ministry fo Iyana Iyesi, Ota, Ogun State, Peace Udoh, bikos dem tok say shi de sel pikin fo di bebi faktri we de insaid di choch.
Dem say 47 yiez old Pasto Peace Udoh don ouredi sel laik 64 pikin bifo men of Lagos Stet Police Command arest am on Sunday afta sombodi go du amebo dia.
Dem gbab Udoh wit one Angela Akpan and won nurse, Mrs. Bukola Ajala, we dem tok se na im de help dem born pikin fo di choch.
Dem say i neva tay we Angela junio sista we bi17 yiez old Goodnews Akpan born pikin fo Ajala's El Shaddai Hospital we de nia di choch.
Naija Languej hie se dem stil de trai to faind hu go bai di pikin bifo polis kom arest Angela fo Sango eria of Ogun Stet on Saturday. From dia, na im di girl kari di polis pipul go sho dem Udoh choch and Ajala hospital on Sunday.
Akodin to Lagos Stet Commissioner of Police, Fatai Owoseni we parade dis pipul bifo niuz pipul fo Ikeja on Monday, “di sospekt dem de ron bebi faktri fo Sango Ota eria. Wi stil de trai to get 64 oda shidren we dem don ouredi sel.”
Enihau, ol di sospekt don dinai se na pikin dem de sel o. Akodin to Peace Udoh, "a don de du dis pasto wok fo 13 yiez nau. A no de sel pikin. A jos de help mai membas born pikin. If di tin pas mai pawa, na Ajala clinic a de kol fo help."
Ajala sef tok say notin konsan am wit selin of pikin o. Shi tel niuz pipul se shi de chaj 15,000 ou 17,000 naira to help pesin born pikin.
Si wetin di 3rd sospekt, Angela tok.
“Mi am from Abak in Akwa Ibom Stet. A bin kari mai sista from awa vilej to di pasto wen ha bele de 4 mont. Na dia shi de til November wen shi born di pikin. Na 17,000 naira a pe di nurse. No bi se a wn sel ha pikin. Na help a help am. A neva sel eni pikin bifo."
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.