Thursday, December 22, 2016

N100K bail fo man we kidnap 9 yiez old boi

Polis don arenj 25 yiez old Triumph Okechukwu fo Ebute Meta Chief Magistrate Court, Lagos fo di kidnap and detenshon of 9 yiez old boi onto di levul of causing injuri.

As dem arenj di sospekt fo court of Monday, polis kom put 2 kaunt chaj of "capturing and detaining with intent to cause harm" on top of im hed.

Afta Okechukwu don dinai se im no komit di ofens at ol, na im di
Magistrate, Mrs Bola Folarin-Williams, grant am N100,000 bail wit 2 surety we get di sem amaunt of moni.

Di Majistret tok se won of di surety must bi di papa ou mama of di akiuz pesin.

Fo nau, shi don ajon di mata to January 13, 2017.

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories