Saturday, December 24, 2016

Hausboi we kil madam bin wn send im girlfriend moni

Polis fo Lagos tok say hausboi Joel Ludguo we kil im madam, Miss Temidayo Adeleke bin de faind moni bai faya bai fos to send to im girlfriend fo Cameroon.

Polis say wetin kos kasala bi se Ludguo bin strong hed se madam must giv am part of im December salari, bot di wuman no kom get naira fo haus as shi jos de riton from forin kontri.

Lagos polis tok-tok pesin Dolapo Badmos tel niuz pipul on Saturday se di sospekt stil de du konfeshon fo  Stet Criminal Investigation and Intelligence Department, Yaba. Afta konfeshon, im go go fes judge fo court.

Mis Adeleke bin de 32 yiez old di taim we im hausboi chuk am knife fo chest.

Badmos kom advais pipul mek dem no de kari haus savant we dem no sabi dia background wel wel. Shi tok se to pik hausboi fo road no mek sens at ol.

So fa, investigeshon don sho se Ludguo bin tek som kain bad bad drugs wen im komit di ofens.

Di maiguard fo di haus we im nem na Abbah tok say na arand 2 mont ego dem emploi di hausboi afta won choch memba bin rekomend am to Adeleke. 

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories