Tempa don stat to de raiz fo Aninri Lokal Govament Eria of Enugu Stet bikos of som Fulani cow pipul we atak 1 fama wit kotlas insaid im rice fam.
Dem tok say di fama, Mr Simon Chukwu bin si dis Fulani pipul wit dia katul as dem de enta im fam fo Egu Ndi Eke, Okofia Oduma arand dat kain 5.30 pm on Thursday, to go chop di rice dia.
As di man de trai to poshu di katul komot fo im rice fam, na so dis Fulani pipul kom vex o. Dem jos kari kotlas tia di man hed o.
As dem tink im don dai, na im dem kari dia cow komot de go dia oun way.
Naija Languej hie se Chukwu de fo Oduma Cottage Hospital nau de risiv tritment.
As tins de nau, Chairman of Aninri Local Government, Mr Chidi Ekwe don hold long mitin wit sekuriti ejensi dem and Alhaji Tobi we bi chiaman of Fulani pipul fo di eria to si hau dem go kul pipul tempa we don ouredi hot.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.