Monday, December 19, 2016

Bikos of fish, Kasali burn im shidren bele wit hot knife - piksho

Na kwich kain papa bi dis? Di man na from dis kontri abi im jos drop from helfaya.

Eniwe, shain yo aiz mek yu si wetin 41 yiez old Alhaji Mumuni Kasali from Owo, Ondo Stet kari im oun hand du im oun shidren bikos dem say dem kolobi fish from pot of soup chop.

Naija Languej Niuz hie se Kasali bin kom bak from wok dat de kom si se dem don chop di onli fish we rimen insaid dia pot of soup o.

As madam kom sav oga fud witaut fish, na im wahala kom burst o. Na so Kasali bigin to rek o.

"A hol mi we bi bred wina fo dis haus? Hau una go sav mi fud witaut fish? "

As madam si se di haus wn kach faya, na so shi tel Kasali say na 9 yiez old Maryam and 6 yiez old Ojonla chop di fish o.

Bot dis Kasali 3rd waif we de sel agbo fo Owo motopak no tel di man se na onli haf of di fish ha step shidren shidren chop. In fact, na shi chop di oda haf bai hasef.

Di tin vex Kasali sotay im go put naif on top stove. As di naif kom red finish, im kom de pres am fo di shidren bele. Si piksho fo onda.

Na dia nebo dem we hie di shidren de krai go kol Civil Defense pipul we kom reskiu dem fo dia fada hand o.

Naija Languej hie se di mama of di shidren don riton from Osun Stet wia shi bin de manej ha laif afta Kasali poshu am fo haus to tek kia of ha pikin dem.

Kasali imsef de insaid cell de kul bodi ontil di taim wen dem go arenj am fo court.

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories