Di Blues straika Diego Costa bin selebret im letest gol and win fo EPL agenst West Brom wit kul beer.
Afta Costa bin post di video wia im de rilax wit beer afta di mach, Chelsea Manija, Antonio Conte tok se im no get problem at ol wit im pleyas if dem de drink beer smol smol.
Costa bin sko di gol we Chelsea kari win West Brom 1-0 last Sunday fo Stamford Bridge.
Na wetin Conte tok wit im oun maut bi dis:
"Smol smol drink gud fo bodi. Dat taim we di mach jos finish, if yu drink 1 beer ou Coca-Cola, i go help yu rikova wota we yu don los.
"No bi se na afta 1hr o, and no bi se yu go drink am plenti. A nou se mai pleyas na konfam profeshonal we get sens. So no nid fo mi to de push dem se du dis ou du dat."
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.