Thursday, December 15, 2016

Reigners Church no gri hie "stop work" o - UCCDA

Akodin to infomeshon we jos de komot from Uyo Capital City Development Authority, UCCDA, Reigners Bible Church International we dia ruf kolaps on top pipul hed on Saturday don de blok dia iye to "stop work" oda from di govament ejensi sins 2013.

Akwa Ibom Stet Edict 13 of 1988 bin giv UCCDA pawa to kontrol tins we get to du wit govament and praivet projekt dem, inkludin dimolishon.

Sombodi fo UCCDA we no tok im nem tok se di church stil de fandeshon levul fo 2013 wen dia pipul go mak am "stop work."

Di pesin tok se UCCDA bin tel di General Overseer to bring di building plan, structural design, Environmental Impact Assessment, EIA, and oda impotant dokument dem we konsan di biuldin fo asesment,  advice, supavishon and apruval, bot di man no gri oo.

Di man tok se ivun di moni we di choch sopoz pe govament and  Nigerian Institute of Town Planners, NITP, dem rifiuz to pe.

Naija Languej hie se fo July 2014, UCCDA stil go tel Reigners Bible Church International to bring dia biuldin plan fo tochlaitin bikos di land wia di choch de get as i bi, bot di pipul kari kotun wul blok dia iye.

“On 16th of July 2014, UCCDA bin mak di ples agen, bot di choch biuldin komiti and kontrakto dem, bikos of dia oun strong hed and ova sabi jos trowe fes de kari go wit konstrokshon.

Dem kom de yab os se wi de fait God. Pastor Akan Weeks ivun yuz im konekshon fo govament kom de opres UCCDA. Na so dem tek biuld dat kain big choch witaut govament apruval o."

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories