Di otoriti dem fo Nnamdi Azikiwe University, Awka don de tok dia maind fo di tok of di town video we bin sho bifo bifo Miss Anambra, Chidinma Okeke de du som kain tins wit her felo wuman onto lesbian levul.
Plenti pipul don de tok abaut di video bot Chidinma don dinai se na im de di fim. Shi tok se bad bele pipul fotoshop her fes go put fo lesbian fim.
As di mata de nau, Unizik manejment tok se dem neva nou wetin to du dis bifo bifo biuti kwin we bi 300 levul student of Medical Laboratory Science bikos dem stil de hie di stori fo di levul of rumor.
Dr Emmanuel Ojukwu we bi
Director of Information and Public Relations fo di yunivasiti bin tel Saturday Sun fo fon se di skul no go fit disaid enitin fo nau bikos di dean of Chidinma fakolti neva ripot di mata to di Vice Chancellor.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.