Toke Benson, dat pesin we dem tok se na im bring di cook we arenj armed robbers we roja $6m from di Managing Director of Nigeria National Petroleum Corporation, NNPC don dinai di aligeshon o.
Dem say Ms Toke Benson bin faind di cook Gabriel Segbedji we leta turn to tif fo NNPC madam, Esther Nnamdi-Ogbue.
Bot si wetin Ms Benson tok insaid di stetment we shi riliz.
“A de rait abaut wetin “Sahara Reporters” of 2nd November 2016 bin tok we dem taitul; Chef of NNPC Managing Director Esther Ogbue absconds with $6m In Cash And Jewelry.
Insaid di poblikeshon, Sahara Reporters bin yan plenti lai lai we bi se;
“Dem say di pesin we rekomend Segbedji fo emploiment to Mrs. Nnamdi-Ogbue na im klos frend we bi Toke Benson.”
"A no nou eni of di pipul we dem menshon dia nem fo di tori. A no rekomend Mr. Gabel Segbedji ou eni oda pesin fo Mrs. Esther Nnamdi – Ogbue ou eni oda pesin fo emploiment.
"Wetin Sahara Reporters rait min se a sabi di pesin we tif moni and di pesin we dem tif her moni. Na im bi se;
i. Mi a bi klos frend of poblik ofisa we de chop moni we pas im salari.
ii. A bring tif fo pesin mek im giv am wok. Dat won min se a no nou wetin a de du and pesin no fit trust mi.
Dis ripot na lai lai ful am and a wn mek di poblik no maind am at ol at ol."
Rimemba se Sahara Reporters bin tok se di NNPC madam no ivun ripot to polis as shi no wn mek pipul hie sins EFCC ouredi de tochlait her mata.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.