Smol taim afta dem free 21 Chibok girls we Boko Haram bin kapsho, Naija soja dem we de fait onda Opreshon Lafiya Dole insaid Pulka fo Gwoza Lokal Govament Eria fo Borno Stet don bring bak 1 mou Chibok girl we bin de insaid di terorist dia wahala.
Akodin to Army tok tok pesin, Col Sani Usman, dis Chibok girl we bi Maryam Ali Maiyanga kari smol pikin of 10 mont we shi born wit Boko Haram pipul.
Usman say dem don ouredi send Maryam to Army hospital fo propa medikal shek op.
Rimemba se di fest Chibok girl we army reskiu na Amina Nkeki we olso bin kari smol pikin we shi born wit Boko Haram insaid Sambisa forest.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.