Thursday, November 3, 2016

Akpeyi don swear to stop Algeria fo Uyo

Super Eagles kipa, Daniel Akpeyi don swear se im go mek shuo se Algeria no put any bol insaid im net fo di FIFA World Cup kwolifaya we dem go ple fo Uyo on November 12.

Akpeyi we dem invait to riples Carl Ikeme we get injuri tok se im go sho se no bi bai mistek koch Gernot Rohr invait am fo di mach.

"Di mach wit Algeria no go de izi at ol bikos dem bi pipul we sabi ple futbol fo Africa. Bot a de shuo se di sem tin we hapun to Zambia fo Ndola go stil hapun to Algeria fo Uyo on November 12." Na wetin Akpeyi tel supersport.com bi dat.

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories