Early morin on Friday, November 18, na im di govament of Singapore hang Naija man Chijioke Obioha afta Supreme Court don trowe di Urgent Criminal Motion we im lawyer, Joseph Chen bin file on Thursday.
Memba of Singapore Anti-Death Penalty Campaign , Mr Ravi, we join bodi wit Mr Chen de poshu di mata na im anauns di bad niuz fo Facebook on Friday.
“Dis morin, arand 6am, na im di egzekushon of Chijioke Stephen Obioha bin hapun. Mi no shuo se ivun im famili fo Nigeria bin get di opochuniti to atend. Smol taim nau, pipul go foget se somtin laik dis bin hapun, ivun togeda wit Chijioke nem. Bot fo wi we de fait dis yeye praktis wia dem go kari human being hang am til im go kom dai, jos bikos i kari drug, di strogul kontiniu." Na wetin Ravi post fo Facebook bi dat.
Dem kach Chijioke in 2007, kom sentens am to death in 2008 afta dem konvikt am se im kari igbo enta dia kontri. Dem say im bin haid som of di Indian hemp fo im travulin bag, kom shuk di rimenin won insaid anus.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.