Saturday, November 19, 2016

Custom don siz bullion van we dem de kari smogul rice (piksho)

Oyo/Osun Command of Nigeria Customs Service, NCS don siz won bullion van we som pipul de yuz smogul rice enta Naija.

Dem say na bank get di moto, bot i bi laik se di draiva kom kari am de du im oun kona kona biznes.

Area Controller  of di command, Comptroller Ogunkua Tope tok se dem diskova plenti 50kg bag of rice insaid di van we bi se na onli moni dem sopoz to kari wit am.

Dem say custom pipul bin taget di bullion van afta dem hie di sikrit of wetin dem de kari am du.

Si piksho of di moto wit plenti bag of rice insaid. 

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories