Pipul don si di dedbodi of smol bebi girl we wia beta klot insaid biscuit carton fo Ikot Ekpene Road insaid Uyo, Akwa Ibom Stet
Dem say di bodi of di pikin bin chenj color afta shi don krai fo long taim we nobodi kom help am.
Som aiwitnes tok se i bi laik se di mama abandon di pikin bikos grand no levul ou bikos shi tink se di pikin na witch.
"Plenti pipul de trowe pikin laik fo dis eria bikos dem tink se di shidren get witchcraft ou ivul spirit. Somtaim, na bikos moni no de to bai fud giv di pikin." Na so won pesin we de dia tok.
Won Mr Okon tok se im bin hie di pikin de krai nia dustbin di taim wen im de go bai fuel fo Ikot Ekpene Road.
"As a hie di pikin krai, a no kom go bai di fuel agen o. A jos hang arand de luk weda di mama go chenj maind kom kari ha pikin bak. A de dia sotay oda pipul we folo hie di pikin krai kom gada dia plenti. Bot as dem tu de tif pikin nawadez plos oda spiritual wahala we fit de, evribodi kom de fia to toch di pikin. Na so di bebi krai sotay shi kom dai. "
Dem say polis don ouredi kol di Ministry of Environment fo nidful akshon.
Si di piksho of di dedbodi of di pikin insaid carton.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.