Saturday, November 19, 2016

13 yiez old skul boi don giv teacher bele fo USA

Won 13 yiez old boi don giv im klas teacher bele fo United States of America afta tu of dem don de folo kona kona de sleep togeda fo nain months.

I bi laik se Alexandria Vera go go prizin as shi don admit fo court se shi bin spoil di smol boi we neva rish to sabi dat kain tin.

Na polis fo Houston arest di ticha bifo dem kom chaj am wit sex abiuz. Dis na afta shi don kari hasef go submit fo Montgomery County police steshon wia shi konfes say shi bin du som bad tins wit di smol boi we dem put fo ha hand mek shi de luk afta am.

24 yiez old Alexandria Vera bin de tich fo Stovall Middle School di taim we shi stat to sleep wit di 13 yiez old boi. Dat taim, dem de tok se na love de shak dem.

Harris County prosekuto dem tok se dis tu pipul bin ple love fo nain months and di boi mama and papa dem kom ivun laik di wuman.

Dem tok se dem de hapi wel wel wen dem hie se dia son girlfriend don get bele.

Dem say Vera we get 4 yiez old dota bin tel police se na olmost evride shi de sleep wit di smol boi. Shi tok se di boi go jos hide kom sleep fo ha haus and early in di morin, shi go drop am fo bus stop mek im enta moto go skul.

Court record sho se Vera bin get bele fo January 2016, bot as shi notis se Child Protective Services don de sho fo ha doormot to ask di boi som kain kweshon dem, na im shi run go komot di bele.

Neighbors tok se Vera de olwez kari smol smol bois we stil de fo sekondri skul kom drink beer fo haus.

Prosekuto dem tok se di wuman sopoz to spend 30 yiez fo prizin, bot akodin to di deal we shi enta wit dem, shi no go spend pas 5 yiez insaid prizin.

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories