Friday, November 18, 2016

On Friday, Singapore go kil Naijaman we enta dia kontri wit igbo

Bikos of komon igbo, Naija pikin go jos dai fo Singapore fo notin? Kai, dis kain tin get as i bi o.

Amnesty International de beg Singapore bai faya bai fos mek dem no kil Naijaman, Chijoke Stephen Obioha on Friday as dem plan to du.

Di govament of Singapore don ouredi infom Obioha famili se court don rijekt im apil to tempa jostis wit mesi. Dem say na tumoro we bi Friday dem go kil am.

Rafendi Djamin, Amnesty International Director fo South-East Asia and the Pacific, tok say dis tin we Singapore wn du no swit dia bele at ol.

“Singapore govament stil get taim to stop di egzekushon of Chijoke Stephen Obioha."

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories