Wednesday, September 7, 2016

Wahala de as Tompolo papa don dai afta rofo-rofo wit soja dem.

Tori we de komot from Warri sho se Chief Thomas Ekpemupolo, di papa of bifo bifo Niger Delta militant oga , Chief Government Ekpemupolo, we dem nou as Tompolo don dai.

Di sinio Ekpemupolo bin dai on Wednesday morin fo won praivet klinik fo Warri wia im bin de risiv tritment fo di injuri we im get fo leg durin di taim we Naija soja dem rosh dia haus fo May dis yie.

Naija Languej hie se tenshon don de raiz fo ol di creek dem insaid Niger Delta bikos of dis tin we hapun.

Durin di inveshon bai Joint Task Force we kom sach fo Tompolo, 84 yiez old Pa Ekpemupolo bin get sirios injuri we kom mek dem kot won of im leg.

Dem say na di injuri kom fainali kil di old man o.

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories