Wednesday, September 7, 2016

Hausa and Fulani don de kil ich oda fo Lagos

Hevi trobul bin hapun fo Agege Abattoir eria fo Lagos on Wednesday as Hausa and Fulani pipul fes ich oda fo fait.

Naija Languej hie se dem kil 3 Hausa pipul fo di fait ivun as 20 Fulani pipul get difrent taip of injuri.

Dem tok say 6 moto and 7 cattle we bilong to Fulani pipul na im dem distroi fo di fait.

Dem say sins Nigeria Railway Corporation dimolish di ples wia Hausa pipul de sel scrap tins dem bikos of cow we train de kari kom dia, dem don de vex se na Fulani cause dia problem.

Bot wahala kom bost on Tuesday wen Fulani man we chop mama put from Hausa wuman no gri pe moni. As shi grab di man to kolekt ha moni, na im di Fulani man kom beat am on top ha fud we im chop.

Na so trobul kom stat o. Bai 1 am on Wednesday, Fulani pipul don oganaiz go kil 3 pipul fo Hausa eria. Bai 5 oklok di sem morin, Hausa pipul don oganaiz dia oun rivenj we kil 7 cow, kom distroi 6 moto and wund 20 Fulani.

Dem say Hausa pipul don de rikrut som gang from Mile 12 and Ojota fo mou atak bikos of dia pipul we dai.

Bot as di mata de nau, polis don de arenj peace mitin bitwin dis Hausa and Fulani pipul, akodin to SP Dolapo Badmos we bi tok tok pesin fo Lagos Stet Polis komand.

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories