Thursday, September 1, 2016

Bag of rice don pas minimom wej - civil savants

Association of Senior Civil Servants of Nigeria, ASCSN, yestade fo Lagos beg Fedral Govament to pe civil savant dem dia salari and alawans we don akumulet bikos wokas de sofa tu moch nawadez.

Akodin to Alade Bashir Lawal, we bi Secretary-General of ASCSN, to pe di moni we government de owe wokas go ivun help di ekonomi.

“Wi biliv se as fedral govament wokas de ol ova di kontri,  if government pe ol awa moni, dat won go help di ekonomi bikos moni go de evriwia and tenshon go ridiuz.

“Hongri de di kontri and pipul de veks. So, as a trade union we lov Naija , wi de tok am mek govament hie, so dat dem go du di nidful bifo wota go kom pas gari."

ASCSN de wonda hau manej  Fedral Govament giv 713.7 billion naira to stet govament dem to pe moni we dem owe dia wokas wen im de owe im oun wokas hevi moni.

Dem kom tel Baba Buhari say bag of rice nau na N20,000, we pas di N18,000 minimum wej;  galon of kerosene na N1,200 from  N400 we dem de sel am bifo.

Dem kom advais di Prezident se if im no de kiaful, im no go de popula agen.

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories