Bishop Bolanle Gbonigi don tok se as Senate President, Bukola Saraki de strogul eni hau mek dem no trai am fo court, i bi laik se di man de kova op som tins o.
Gbonigi bin tel Punch on Wednesday say fo eni poblik ofishal to trai to stop im oun trayal di we Saraki de du, dat won sho se im de haid somtin.
Im kom ad se dat kain tin de shemful and eni poblik ofis holda we disav im pozishon no sopoz to du laik dat.
Hie wetin im tok.
"Di Senate Prezident trayal de yeye Nigeria.
"Fo Senate Prezident to waka from fest court to Appeal Court sotey im rich Supreme Court jos to mek shuo se dem no investiget am no gud at ol. Di tin de mek mi shem. Hau im go de waka waka laik dat?
"If wetin dem akiuz am no bi tru, wai im no go alau Code of Conduct Tribunal du dia wok?
“Na di duti of enibodi we dem akiuz of enitin to sho ol of os se im hand de klin. No bi se im go de waka abaut de blem pipul we de fait koropshon.
"If enibodi no want mek dem investiget am, dat won sho se i get wetin dat pesin de haid."
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.