Di world champions fit bi favorait fo Saturday mach fo Bordeaux, bot dem stil neva manej to win di Azzurri fo eni kompetitiv akshon.
Di 1970 World Cup semi-final we meni pipul bin kol ‘Game of the Century’ de dia; di ‘Tardelli moment’ fo 1982 World Cup fainal de ; tdi ‘Gol di Grosso’ fo 2006 de and olso Mario’s muscles fo 2012.
I don tey we Germany and Italy de jam fo kompetishon bot na onli Azzurri de enjoi di glori.
Na 8 taims na im dis 2 kontri don jam in front of di world and na 8 taims Germany kari emti hand waka.
As dem de pripa fo dia Saturday nait mach wit Antonio Conte im Italians we don de raiz chest, Germany nou se dia fest eva win ova dia old enemi fo di 9th taim we dem de mit fo kompetishon na di onli tin we go help dem rich semifainal fo Europe fo di 3rd taim.
Se kontri laik Germany we don win 4 World Cup and 3 European taitul neva faind di fomula to win Italy get as i bi. No bi se dem no de mit evritaim, bot no taim we 10 yiez don pas we dem no mit. No mata hau gud Germany de fo eni kompetishon, i de tof fo dem to kros Italy.
Bot wai die Nationalmannschaft onli colekt 4 draw and 4 defeat from di 8 machis we dem don ple wit Italy?
Werner Mickler we bi pesin we dem sabi fo sports psychology, we de lekcho fo German Sport University Cologne, we bi se na im de handul psychology of coach edukeshon fo DFB, tel
Goal se di tin we de wori Germany de fo hed.
“I de olwes get to du wit somtin we de hapun fo hed.
“The fest point bi se no bi evri pleya de get dis negetiv ekspiriens. Di sekond tin bi se wi bi world champion, so wi get swaga.
"Di 3rd point na di tin we de hapun ol di taim : weda di tin we don hapun bifo go stil hapun in di fusho. Bot evri gem na niu gem. So, i dipend hau di pleyas dem ou di tim handul am."
Na dat. psychological fakto de help Italy to menten dia rekod we bi se dem no de luz to Germany.
2006 World Cup semi-fainal go eva rimen won of di best sho fo intaneshonal futbol history bikos of di end-to-end nesho of di entaya 120 minits. Bot jos di mach bi laik se i wn finish 0 - 0, to enta penariti we Germany don masta, na im , Fabio Grosso and Alessandro Del Piero ich sko fo di last tu minits of ekstra taim .
If yu luk hau i de bi, dat won no rizembul Italian pafomans, bot di Euro 2012 semi-fainal na im bi laik Azzurri tradishon. Mario Balotelli im tu gols fo fest haf bin giv Italy somtin to selebret. Ivun dou Germany sko won gol as di get wn finish, no taim we Cesare Prandelli men sho se dem wn luz di mach.
As di 1970 extra-taim slugfest and di 1982 slow-burner bin sho, Italy don get plenti difrent wez to win Germany.
Di last taim we die Nationalmannschaft manej enitin we rizembul win agenst Italy na fo Euro 96 wen Gianfranco Zola mis penariti we mek di mach finish 0 - 0 fo Group C last mach. Germany bin go tru and Italy waka go home. From dia, Berti Vogts’ said win di kompetishon.
Korent koch Joachim Loew nid to faind we to win Italy on Saturday nait.
"Yu nid to konvins yo bois se yo plan go wok, and go go arenj difrent difrent plan dem.
“So ivun if plan A no work, plan B de plos plan C - den yu go fil se notin de hapun.
“As dem win World Cup, Germany nou se dem fit kontrol di gem. I mek se to kontrol di mach. No bi se yu go jos de riakt to wetin yo oponent de du.
“Wahala tim na onli fo yo maind.”
Germany nid to faind ansa to Italy on Saturday if dem wn bikom European champion on top of di World champion we dem bi.
Kris Voakes bin rait dis atikul fo Goal bot na Steve Igbokwe translet am to Naija Languej.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.