Govano Ayodele Fayose of Ekiti Stet don tok hau mosh im get fo im 2 akaunt we EFCC bin friz fo Zenith Bank.
Fayose bin riliz stetment on Sunday wia im tok hau mosh de di 2 akaunt dem.
“Fo mai tu akaunt we dem don friz so, a get N300 million fo di "fixed" deposit won and N82 million fo di oda won. Di tu akaunt and mai propati dem de insaid mai Asset Declaration Form.
"Dem don stat di sem tin we dem du fo 2006 and bai di gres of God, dem go fel. Di won we dem du fo 2006, Supreme Court bin diklia am ilegal. Na im bi se sombodi bin lai.
"Ol of os no go fit de fo APC. If not, demokresi don dai bi dat. Pipul de hongri bot na to poshu opozishon dem sabi."
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.