Monday, July 25, 2016

Psquare: Peter and Paul don setul

I bi laik se Psquare twin broda dem, Peter and Paul Okoye don setul dia palava. Dis na akodin to wetin Peter tok fo Instagram.

I don tey we dis tu brodas plos dia twin broda Jude de fait sotey dem kom go solo.

Bot afta dia last kworel we involv won sho we Paul bin du fo Congo, dia aiz don klia.

"Mai dear fans, P-Square don kom bak . Awa oun na joni we stat from awa moda bele. Na joni we stat from praimari skul,  to St. Mulumba College, kom rish University fo Abuja. Na joni we wi don shia smol pikin dream and memori dem. We kom bak bikos broda no de let im broda waka elon. Wi kom bak bikos wi don trai di lonli rod si se no bi di sem wit wen wi de waka togeda."

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories