Tuesday, July 5, 2016

Boko Haram de enta Lagos evride - Naija Army

Naija Army don tok say na evride Boko Haram pipul de enta Lagos and oda stet dem.

Di General Officer Com­manding GOC, 81 Division of the Nigerian Army, Major General Isidore Edet tok se na evride dem de arest Boko Haram pipul fo Lagos and oda stet dem.

Na on Monday fo di choch savis of Nigerian Army Day Celebration we dem du fo Saint Charles Lwanga Catholic Church, Ikeja Cantonment, Lagos, Edet tok dis won.

"Olmost evride, wi de arest Boko Haram pipul we de ron enta Lagos jos laik dem de ron go som oda ples dem.”

“Dem si se di war don pas dia pawa, so dem de ron nau. Bot army de join bodi wit oda sekuriti ejensi dem to de kach dem evride.

“Fest taim, dem de dinai se dem no bi Boko Haram, bot wen wi tochlait dem wel wel, dem de tel os wia dem bin fait bifo, hau dem kil soja and hau dem bomb post ofis fo Maiduguri and so on.

“Bai den, wi go jos send dem to haya otoriti to giv dem di kain tritment we Naija law tok se dem sopoz to get."

Edet stil yuz di choch savis to tank Naija soja dem we sakrifais dia evritin fo di sek of Naija pipul.

“Som of una de waka wit won leg ou won hand; som ivun de yuz crutches ol bikos dem fait Boko Haram  so dat wi go rimen won kontri.

“Laik won yie ego, dem de kari os du yeye fo poblik. If yu tok dat taim, sivilian go tel yu mek yu klos yo maut go fait Boko Haram.

“Bot tode, wi tank Olmaiti God we tren awa hand fo war se Im don komot shem fo awa fes.

“And nau, Naija pipul de hel os se wi bi dia soja and wi de trai."

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories