Afta som agbero pipul go damej som BRT bus bikos of won strit hoka wey BRT moto bin jam, Lagos Stet govament don stat to de arest pipul we de sel maket fo rod.
Daily Trust de ripot se na on Monday we bi July 4, 2016 Kick Against Indiscipline, KAI task fos pipul bigin kach ol dis strit tredas dem we no de hie.
Dem say if dem kach yu dey sel fo rod fo Lagos, yo ponishment na to go prizin fo 6 mont ou to pe fain to of N90,000.
Govano Ambode bin tok se di law we dem de yuz na di Section One of the Lagos State Street Trading and Illegal Market Prohibition Law 2003 we tok se nobodi fit sel maket fo som kain eria fo Lagos.
Daily Trust tok say som of di ples KAI arest strit hoka dem na Maryland, Oshodi, Ikeja, and Ojota. Fo KAI office we de fo Alausa, dem si som pipul we bi se na strit hokin bi dia ofens.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.