Saturday, July 16, 2016

Bad bele pipul kil gold man fo India (si piksho)

Som bad bele pipul don go kil Indian moni lenda, Datta Phuge last Thursday nait.

Datta Phuge bin enta niuz big taim in 2015 wen im bai won "shirt" we dem mek wit 3kg of pio gold we rish $250,000.

Polis say di 12 pipul we atak Phuge bin invait am to "birthday" pati fo won opun ples fo Dighi eria insaid Western Pune.

Na dia dem kil Phuge we pipul de laik to kol di gold man, bot dem no tosh im 22 yiez old son we im kari go di pati.

Polis Inspector Navnath Ghogare tel say investigeshon don stat to nou hau Mr Phuge manej enta dat opun graund wia dem kil am.

Phuge na pesin we de laik to wia gold ol ova im bodi. Fo hand o, nek, nokul, evriwia na gold.

Fo 2013, Phuge bin tel BBC say: “Som pipul de ask mi wai a de wia plenti gold fo bodi. Na wetin a want bi dat.

"Pipul de poshu difrent ambishon dem. Som pipul we get moni wn bai Audi ou Mercedes and oda big moto dem. Wetin a chuz na gold."

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories