No bi niuz agen se Prezident Muhammadu Buhari shidren, Yusuf and Zahrah don grajuet from won big yunivasiti fo UK.
Bot wetin de on bod bi se Yusuf and Zahrah plus dia sista Halima Buhari Sheriff we jos grajuet from law skul bin arenj won hevi pati to selebret dia grajueshon and kol to "bar" wit dia frends dem.
Kogratuleshon to Baba Buhari and ol im shidren we de selebret. Baba no laik to spend moni bot i bi laik se im pikin dem sabi spend am.
Si Aisha Buhari wit ha shidren and dia frends fo piksho as dem de selebret grajueshon.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.