Prezident Francois Hollande don diklia 3 dez mek France yuz krai fo di 84 pipul we won Tunisia man kari trela go kil insaid "crowd" as dem de selebret Bastille Day.
Di man we du di ivul na Mohamed Lahouaiej Bouhlel and im get waif wit 3 shidren.
MailOnline tok se Bouhlel no bi nomal jihadi as im de bit im waif and im de chop pig mit.
Si wetin Bouhlel kozin tel MailOnline.
‘'Notin konsan Bouhlel wit relijon.. Im no de go mosque. Im no de pre. In no de du Ramadan. Im de drink alcohol, chop pig mit and smok igbo. Ol dis tins de bad fo Islam.
'‘Im no bi Muslim, im na shit.
Im de bit im waif. Dat mai kozin na yeye pesin.’'
Bouhlel na from Tunisia bot im bi sitizin fo France.
Si im fes fo piksho.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.