Saturday, June 4, 2016

Wowo Naija team fombul fo Korea as Denmark hama dem 6 - 2

Nor bi smol fombul Naija Olympic team bin fombul on Saturday morning fo di Suwon International Tournament wey dey shele fo South Korea as Denmark kom hama dem 6 - 2.

Na di sekond stret taim wey Samson Siasia tim dez luz mach fo di tonament bi dat.  Fo dia fest mach wey Korea win dem 1-0, Siasia bin tok se di bois taya.

Fo 26th minit na im Denmark bigin flog awa Dream Team VI afta Erhun Obanor wey bi Naija pleya tap bol insaid im oun kipa net.

Afta smol taim fo 34 minit, Denmark skor dia sekond gol as
Emil Larsen faya korekt shot insaid Naija net.

Smol taim agen, Larson kom skor anoda gol sotey im kom get hat trik against Naija.

Na so Naija pleyas jos dey wowo dey go wey Patrick da Silva and Emiliano Marcondes ivun skor dia oun.

Bai di taim wey di match rish 75 minit, Denmark don finish Naija wit 6 gols.

As Dream Team post dey lik laik basket, na so di straikas dey trowe bol enihau.

Na wen mach don dey finish, na im Abdulrahman Taiwo wey bi se im jos enta di mach manej skor 2 gols fo Naija.

0 comments:

Post a Comment

Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.

Categories