On Friday fo Abuja na im Labour opun maut tel Federal Govament ho ha say Naija ekonomi don skata and Naija pipul dey sofa no bi smol.
Na fo di 10th Triennial National Delegates Conference of the Trade Union Congress of Nigeria, TUC, na im dia President, Mr. Bobboi Kaigama tel govament se :
"fo Naija tode, ekonomi don wowo. I don komot fo alainment kpatakpata. Notin dey muv. Wok no dey and tins dey kost. Awa moni wey bi naira dey fol enihau. Boko Haram wahala dey dia. Herdsmen wahala dey dia. Niger Delta militant dey dia wit dia oun trobul plos plenti oda wahala dem wey ful Naija. "
Kaigama kom tel govament se di kain chenj wey Naija pipul nid na di chenj wey go arenj Naija mek tins beta laik oda kontri dem.
Fo im oun tok, Labour Minista wey bi Chris Ngige kom tel Naija pipul say govament nou se dem dey sofa, bot mek dem jos dey manej dey dia laif as govament dey trai to mek tins beta.
0 comments:
Post a Comment
Dear readers, your comments are appreciated. Please keep them relevant to the subject matter at hand.
For enquiries and other useful information, you can email us at naijalanguej@gmail.com.